menu-iconlogo
logo

Motivation

logo
avatar
Eriggalogo
magomerlino1logo
Sing in App
Lyrics
It's Victor AD na na na

KingPaper Kulboy

Pikin wey dey find party rice

No suppose to fear dance eh fear dance eh

And as I come with my red eye red eye

Make dem give me chance eh give me chance eh

You wey no know the way song take start

You dey hurry to dance eh to dance eh

How e do you now as you dance Galala inside Azonto

My biggest motivation

Na those men wey elbow me lost eh

Oh my biggest motivation

Na those days I no see food chop eh

I say my biggest motivation

Na those wey say hustle no go pay oh

Omo my biggest motivation

Na those wey dey hate ah

2 seconds dem dey motivate us

See If e want burst na 2 seconds 3 too tey

Day break everywhere burst my woman pay

This year we go give wahala problem

Where the girls dey use my Benz dey go toll them

In case dem want dey assume

Na to spray the money anyhow like another man perfume

If SARS want jump I naked follow them

Wetin dey happen officer me and you get problem

Old Warri

Me no bother nobody so no dey bother me

Hold this funds take press

Everywhere hard I know e no easy bros

Even for hell fire now devil sit down dey press

Respect who get but fear who never collect

Him first taking na there area take scatter

Street na general market you fit pick two

Suspension na hold on rough character

My biggest motivation

Na those men wey elbow me lost eh

Oh my biggest motivation

Na those days I no see food chop eh

I say my biggest motivation

Na those wey say hustle no go pay oh

Omo my biggest motivation

Na those wey dey hate ah

2 seconds dem dey motivate us

See I dey Lagos dem want turn the boy to houseboy

But Oluwa no gree e too love the boy

No joy my guy my guy no dey the street

If trust dey then water for no fit dey cook fish

Idol mind dey opposite devil workshop

I no fit be apprentice I get work to chop

I no dey proud about am but wetin man go do

Pikin dey one side abi him no go chop go school

If mouth want tear my brother make e tear finish

The worst thing to happen to man na see finish

When I die write say I try for my grave

Life na market and everybody here come trade

Omo the rubbish wey be say my eye done see

Even this water when I cry e no fit commot am

I no fit complain e join wetin give me voltage

Tomorrow get belle witch no fit abort am Iai lai

Pikin wey dey find party rice

No suppose to fear dance eh fear dance eh

And as I come with my red eye red eye

Make dem give me chance eh

You wey no know the way song take start

You dey hurry to dance eh you don go mess up now

How e do you now as you dance Galala inside Azonto

My biggest motivation

Na those men wey elbow me lost eh

Omo my biggest motivation

Na those days I no see food chop eh

I say my biggest motivation

Na those wey say hustle no go pay oh

Omo my biggest motivation

Na those wey dey hate dem dey hate o

2 seconds dem dey motivate us

Omo na the street be this o abeg

When landlord dey turn to tenant 2 seconds

Form big boy very soon you go dey chop remnant

You no know say life na general market

Dem dey give some people suspension

Suspension na okere prison

4 years you dey wait like pension 2 seconds

Motivate yourself man

Everybody with their motivation abeg

Still on collecting confirmation na must abeg