menu-iconlogo
logo

Dem No Get Two Heads

logo
Letra
Ayyy heh

Ayy

It's your boy Erigga new money baby

Hey Ibu how you dey how your matter be

Shey e don reach like 2 months when we never see

Sorry say I never come I dey miss you die

I like hold you once again I like kiss you die

This Warri when I dey many things dey happen

But no worry like 2Face my eye sharpen

Just recently Qwotee shoot dem look jam no

Kill Tara I dey hear say Toro don go

My heart cold

Like say rain wan fall

Thinking don cause headache e be like say my brain wan fall

Me and this people whe I call dey pursue one thing

Like rake for garden we just wan gather green

Blood money no dey last taking dey quick cast

School 4 Years na who get money na im dey pass

I like do G see nobody to put me through

But if I put my eye down e no reach me do

Na mumsi I dey reason how she go feel

Erigga my pikin no fit rob or steal

With the kind Jam wey e dey kill e fit make more than 1 mill

Snowman believe am die na im make e give am deal yeah

Make you try understand say na so e be

If I no make money God no go happy with me because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

Wrap the kpo for my sense go dey smoke for sky

E better say my teeth pull than my prick to die because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

Now look me into the street f*ck your mumu deal

My pocket swell up like person whe juju kill

I dey rub bones like that guy man for kuvuki

Blow Igbo smoke like say my mouth na Suzuki

Ask my Cousin Rukky na me be the street

No be say na mouth look I even gat the blue print

I don blow kpom with gees whe be say like this

Trigger be like woman breast e no hard them squeeze

Na you know take am do joke until men point you

With that AK semi collect your 2.2

Blow your fuse burst with tools whe go make your blood reduce

Use the bar from your pigeon hole take go booze

Money no dey young men dey see their period

Keep your always na towel we need serious

December no far e short like Caller Tunes

So for the bar many guy men dey can her toolz yeah

Make you try understand say na so e be

If I no make money God no go happy with me because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

Wrap the kpo for my sense go dey smoke for sky

E better say my teeth pull than my prick to die because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

If na lie you wan hear comot this CD

Go play that your guy when dey rap like 50

See I don't give a f*ck if you feel me or not

Cuz the street dey feel me this is why I'm hot

Like every police station Erigga get cell

Pass the amount whe be say them sell Celtel

Because like hand whe dem shake all my lines dem bad

Wole Soyinka flow to define them hard

I no need to go L A if I wan see blood

All I gotta do is just to order the word

Na then you go surprise when small jaguda

Go burst your head with for kamala with gulder

So omo boy pin down I no dey fear your threat

I don s**t death many times go look my toilet

You nor need to tell me say you dey feel this s**t

I hear watin I dey talk I know say I dey kill this s**t yeah

Make you try understand say na so e be

If I no make money God no go happy with me because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

Wrap the kpo for my sense go dey smoke for sky

E better say my teeth pull than my prick to die because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

Make you try understand say na so e be

If I no make money God no go happy with me because

All these people when dey make am so

Dem no get two head yeah

Dem no get two head yeah

New money baby

I got Snowman what it is

I got Ray X on the mix and the beat

And everything you know what I'm saying

We just doing our thing