Nas, All Motivational speakers now Dey short of words
Because dem no see money buy meat cook food for thought, chai
Nigeria I for hail thee
but I de vex our leaders de fail me
Primary school dem call us leaders of tomorrow
29 years now same old story big ojoro
Same strategy empty promises they still flex
While we wallow deep in poverty, see sense
Election time then, dem bin come with rice,
People wey sell their vote now don dey pay the price.
Okay how much be bread for your area?
How much be rent for your zanga?
We gats flush these guys out like Eric ten hang
Before them carry nigeria go where go really hang
I for say make we flog them like rearers treat cows
But no strength me wey de rap never chow