menu-iconlogo
huatong
huatong
avatar

Why

Victor Adhuatong
mythad1huatong
Şarkı Sözleri
Kayıtlar
It's Victor AD na na na

Bros E for better if them slap me

Say e for better make dem throw me punch

I just got back from London

Aih! my people still dey sell their vote

For bag of rice wey no carry beans

The food no go complete if e no carry meat

Aih

Before I see welcome to Nigeria

Na blackout I take know say I dey Nigeria

It's so painful

Say the story no change at all

And it's so painful

Say the leaders no change at all

I believe say you get the voltage and power to rise when I fall

Na the reason why I put you there

I believe say you get everything to make this people tall

Na the reason why I put you there

And now you don dey break my heart

Say, make the people cry

No be the reason why I put you there

And if I get the power to change it, I go bring you down

But who next I go put for there?

And I say

Oh why? oh why? oh

Oh why? oh why? oh

Eheh

Oh why? oh why? oh

Oh why? oh why? oh

What if I tell you 'I was right'

And I tell you 'you were wrong?'

That everything will be alright

But only inside my song

You will find peace of mind

Because in a crazy world

Who everybody dey call craze, na em normal

Check Instablog

Which country for this world dey use 50 years do light

I dey London dey drive, I no even use full light

Cause everywhere bright

Even bright pass we leaders

For their mind, we be smallie with primary three reader

Tobore say he dey go stadium

Na big kolo

As we dey see am so, e wear reach for party polo

So when you feel say you dey fool us with yeye promise

We dey fool you too

Your lies dey make us wan vomit

I believe say you get the voltage and power to rise when I fall

Na the reason why I put you there

I believe say you get everything to make this people tall

Na the reason why I put you there

And now you don dey break my heart

Say, make the people cry

No be the reason why I put you there

And if I get the power to change it, I go bring you down

But who next I go put for there?

And I say

Oh why? oh why? oh

Oh why? oh why? oh

Eheh

Oh why? oh why? oh

Oh why? oh why? oh

As e dey pain me eh

Victor Ad'dan Daha Fazlası

Tümünü Görlogo

Beğenebilirsin