Abeg
It's paper boy ah
How e be?
A trip to the south men
(A-DeeJay Toxic) na giro matter
If I tell you my life, how I take reach here
You no go believe, who dey there? Abeg bring chair
One polo one jean, rotten palm sleepers
12 years old I don stop to dey sleep house
Ring the bell, 12 O' clock suppose to be break in time
But wit me and Kewe wey omo, na taking time
Tear people school bag, remove their belonging
Big down, I don't know what I fit call me
Headphone for my ear, one old walk man
Dey jam 2Pac, of course I no get work
Morning 'till night
We dey area dey gamble, dey struggle
Police fear, rush come wear us government bangle
My role model that year na dem bros Okpe
Na wen e die I know say na ole go le
Community dey find us, we dey bush dey cush
Officer relax you never know who be the bush here
If not for Jehovah
My life would have been over
Na baba God dey bless me o
E dey bless me o, e dey bless me
I no be super man o
But my life dey e hand o
Na baba God dey bless me so
E dey bless me o, e dey bless me
(If not for Jehovah)
When I tell them my dream, dem go start to laugh
Erigga relax who don blow with rap for waff
Okere prison dey call, you go soon join your boys
But deep down I know say the world go hear my voice
From street to street dey kpuff who talk say you dope
Erigga good, the problem be say you broke
So when time reach to choose Bible or riffle
I pick Bible, flown the backstreet with kpo
Money start to enter, I begin book section
More music, more show, less police station
No more police statement
Now na account statement
Call dem o boy, how far
How dem make that payment
If not for Jehovah
My life would have been over
Na baba God dey bless me o
E dey bless me o, e dey bless me
I no be super man o
But my life dey e hand o
Na baba God dey bless me so
(Baba God, Baba God, na im dey bless me)
E dey bless me o, e dey bless me
(If not for Jehovah)
Na the moral of the story, give up no join
E fit dey hard, na country man stay on point
Fail to plan, my brother, na plan to fail
Who go better go better, na tey e dey tey
No be stone you dey cook
My brother na beans, when e done
Tear everywhere like rugged jeans
I don see men hammer, I don see men broke
To the point dem no fit even buy gbana smoke
Who belle full go hungry
My brother wey you na brain
Broke today, your men go throway you
Money dey, but I dey grind like upcoming
Anything wey make me fall
E no go funny at all men
If not for Jehovah
My life would have been over
Na baba God dey bless me o
E dey bless me o, e dey bless me
I no be super man o
But my life dey e hand o
Na baba God dey bless me so
E dey bless me o, e dey bless me
If not for Jehovah
If not for Jehovah
Na baba God dey bless me o
E dey-
E dey bless me o, e dey bless me o
A-DeeJay Toxic