menu-iconlogo
logo

Oyo

logo
가사
Pull up with the squad, give them knuckle make them chop

"Erigga don make am now" Na wetin them dey talk

How much for the drink? They no wan know, they don dey pop

Area too dey overdo na why police too dey burst

Dawg, who they shoot that one na him luck

Wetin police hate pass na two and dreadlocks

Ip yolo, Ip yolo

We no get money for babe, Teddy p yolo

Hunger dey slap man for face for where him wife dey

Him last hope na merrybet, na there him life dey

Nepa dey f*ck up steady, dey use the light play

We no dey see the light, no be say we no like pay

My mama when retire, government never pay her shishi

You need to see the responsibility when them pack give me

My text message, na family account full am

Na man dey rule man, so tell me wetin man do man

Iju nwa siri ke

Echekwe nne madu, ncho nwegi

So you better shine your eye

Because this life e be like market, ngb'on nnewi

Oyo, this life is personal

Everybody them dey run their race oh

Oyo, you are on your own

If you no get anything wey be your own

I'm here sipping this Henny

With my thought molding out

Looking at my own thoughts

It's like, my thoughts are feeling proud

Like what the f*ck are you thinking?

Don't you know you are special?

Don't you know you are blessed?

Even in this recession

See, other people took a break

They let recession recess 'em

Ko kan aiye, why you stressin'

To ba fi ko kan aiye, bring the wesson

I make money and spend little with the people in the hood

Let's say I like supporting small business in the hood

Cherry get pikin wey dey uni and she dey sell beer

She get another little one with pretty girl flair

I mean, she also has to think about some health care

Awa kon wo some guys, how they know of welfare

But I gats move because the streets is not a good place

If we had a choice, we'd all agree it's not a good place

There's nothing cool about mosquitoe bites or zero light

(There's nothing cool about mosquitoe bite or zero light)

Iju nwa siri ke

Echekwe nne madu, ncho nwegi

So you better shine your eye

Because this life e be like market, ngb'on nnewi

Oyo, this life is personal

Everybody them dey run their race oh

Oyo, you are on your own

If you no get anything wey be your own, oyo

Yeah, na the beginning e hard oh

Another pikin dey the yard oh

When go sell recharge card oh

Situation very bad oh

No father figure, na the way when I take grow up

Give up no join, how you think say I take blow up?

E be like Val Regina show when I sit down with Ned

Instead of money, I collect him number instead

I'd rather stay connected, 'cause money dey distracting

You fit dey feel say you make but here's where you lacking

Police don burst you, which person number na him you wan call?

Hope no be me, 'cause I no go even see your call

If no be money you dey talk, abeg beware from me

I busy die, na why you no dey hear from me

But if na money you dey talk, you go hear from me

In short, no make any move until you hear from me